(Nigerian Pidgin English Poem By: Chidi Anthony Opara)
I bin hear di time
Wey Naija Presido
Bin yan say
Boko na ghost.
Presido
Come yan more say
No forgive for ghost.
Now another yan
Don enter town.
Di new yan be say
Presido dey think am say
E good to forgive Boko.
Di way wey man pikin
Dey see am now,
E be like say
Dat ghost
Wey Presido bin see
No come be ghost again.
Di true tori be say
Boko no be ghost,
Na masquerade.
Di man pikin dem
Wey wear di masquerade
Na dem dey show face so,
Na dem dey yan with Presido,
Na dem dey yan forgive Boko.
Di final true tori
Come be say
Naija Presido
Bin see masquerade,
Come think say
Na ghost wey im see.
Ghost na ghost,
Masquerade na masquerade.
Boko no be ghost,
Na masquerade.
Reproductions in part or in whole, in whatever forms, of ChidiAnthonyOparaPoetry/Quotes except for non-profit information and education purposes, without a written permission from PublicInformationProjects is not allowed.
No comments:
Post a Comment