By Chidi Anthony Opara
Waka waka
Carry Naija Presido enter London,
Birthday matter
Waka join Presido for London,
Presido birthday joli
Come happen for London.
Amebo dem come yan say;
Naija chop dem,
Oyibo chop dem full table.
Di yan too be say;
Ogogoro,
Brandy,
Odeku
All full table.
Di yan come dey waka.
As im dey waka,
Amebo dem dey wear am cloth.
Di yan come waka
Reach where e come be say;
For dat Presido birthday joli,
Presido
Dey shak ogororo,
Dey shak brandy,
Dey shak odeku join.
Wetin Naija people hear be say;
Di next day
Presido sick go hospital for London.
Amebo dem say;
Na hangover make Presido go hospital.
(This Nigerian pidgin English poem is presented as a social service, all rights reserved.)
You received this message because you are subscribed to the "USA-Africa Dialogue Series" moderated by Toyin Falola, University of Texas at Austin.
For current archives, visit http://groups.google.com/group/USAAfricaDialogue
For previous archives, visit http://www.utexas.edu/conferences/africa/ads/index.html
To post to this group, send an email to USAAfricaDialogue@googlegroups.com
To unsubscribe from this group, send an email to USAAfricaDialogue-
unsubscribe@googlegroups.com
---
You received this message because you are subscribed to the Google Groups "USA Africa Dialogue Series" group.
To unsubscribe from this group and stop receiving emails from it, send an email to usaafricadialogue+unsubscribe@googlegroups.com.
For more options, visit https://groups.google.com/groups/opt_out.
No comments:
Post a Comment