Tuesday, February 21, 2012

USA Africa Dialogue Series - All Of Us Na Victim (Nigerian Pidgin English Poem)

By Chidi Anthony Opara
 
Oga big bank governor,
You dey share our money
For your village bomb victim dem
Like say na your money.
As you dey share,
Make you share reach everybody,
All of us for Naija na victim.
 
Who dey for Naija
Wey no be victim?
 
Some na bomb victim,
Some na disease victim,
Some na thief victim,
Some na hunger victim.
Which one I go talk,
Which one I no go talk.
All of us for Naija na victim.
 
Even sef
We be your victim.
You siddon for big bank
Dey speak big grammar,
Our money dey disappear.
Di small one wey remain
You carry go share
For your village bomb victim dem.
You share two,
You say you share four.
 
Oga big bank governor,
As you dey share
Make you share reach all of us,
All of us for Naija na victim.


More Dey For: Na For Poems
 

No comments:

Post a Comment

 
Vida de bombeiro Recipes Informatica Humor Jokes Mensagens Curiosity Saude Video Games Car Blog Animals Diario das Mensagens Eletronica Rei Jesus News Noticias da TV Artesanato Esportes Noticias Atuais Games Pets Career Religion Recreation Business Education Autos Academics Style Television Programming Motosport Humor News The Games Home Downs World News Internet Car Design Entertaimment Celebrities 1001 Games Doctor Pets Net Downs World Enter Jesus Variedade Mensagensr Android Rub Letras Dialogue cosmetics Genexus Car net Só Humor Curiosity Gifs Medical Female American Health Madeira Designer PPS Divertidas Estate Travel Estate Writing Computer Matilde Ocultos Matilde futebolcomnoticias girassol lettheworldturn topdigitalnet Bem amado enjohnny produceideas foodasticos cronicasdoimaginario downloadsdegraca compactandoletras newcuriosidades blogdoarmario arrozinhoii sonasol halfbakedtaters make-it-plain amatha