By Chidi Anthony Opara
Day break
We dey write,
Day dark
We dey write.
We wey say we be writer,
We dey write
Like say we be better people.
We dey write
Di bad thing dem
Wey bad people dey do.
We wey say we be writer,
We dey write
Like say we be better people.
For inside government
We dey put eye,
For inside God work
We dey put eye,
Even inside other people matter
We dey put eye,
We dey put eye everywhere.
We wey say we be writer,
We dey write
Like say we be better people.
For under di table
Wey we siddon dey write,
For under di chair
Wey we siddon dey write,
Plenty dirty full ground.
We know say di dirty dey,
We no dey write dat one.
We wey say we be writer,
We dey write
Like say we be better people.
More Poems Dey For: Na For Poems
No comments:
Post a Comment