Our country
Na bend bend country.
Our government dem
Na bend bend government.
Na im make
Our life bend bend.
We dey do bend bend election,
We dey carry bend bend people
Put for inside office.
Di bend bend people
Dey choose bend bend people
To work with.
Everything bend bend,
Our pocket sef
Follow bend bend.
Christmas
Don bend dey come.
New year too
Don bend dey come.
Bend down market
Na im dey help us.
Bend down cloth dem,
Bend down shoe dem
Bend down everything.
Bend down market
Na im dey help us.
Published On: Na For Poems at 11/20/2011 06:25:00 AM
No comments:
Post a Comment