Me too wan do am
Originally Published On: Na For Poems at 11/17/2011 09:58:00 AM
But I no fit do am.
I been wan reject
One yeye award like dat
Wey dem been wan
Give me for dream.
For di dream,
People gather well well.
Big big Abuja people
Been gather for one place
Like dat for inside Abuja.
Dem dey wait for me
To come collect
One yeye award like dat
Wey carry plenty money inside.
One mind dey tell me
Make I reject di award,
Another mind dey tell me
Make I no reject di award.
Na im I remember
Say hungry dey for house.
I remember
Say school fees no dey,
House rent no dey,
Nothing dey.
I remember
Say work no dey,
Business sef no dey,
I remember
Say man pickin no fit reject di award.
Na im I come waka
Dey go small small,
I come waka
Dey go collect di award.
As I waka reach di place,
Na wake I come wake.
Originally Published On: Na For Poems at 11/17/2011 09:58:00 AM
No comments:
Post a Comment