Sunday, December 4, 2011

USA Africa Dialogue Series - "Occupy Dey Come" By Chidi Anthony Opara

Where I dey
Dey observe Naija,
I see one occupy
As im waka dey come.
Dis occupy
Be like better occupy,
Occupy dey come.

One yeye occupy
Been don come before,
Na for Abuja in come,
But im no fit occupy,
Fear no let am occupy,
Na Internet im occupy.

Di worry be say
Dis occupy wey dey come so,
E be like say
Im like Internet too.
Internet good shaa,
But Internet na talk talk
And write write.
Occupy na action,
For Naija now,
Na action we want.

If dis occupy go fit occupy,
All di yeye people
Wey occupy our life,
All di subsidy big belle,
We go occupy dem.


Published On: Na For Poems at 12/04/2011 06:25:00 AM


No comments:

Post a Comment

 
Vida de bombeiro Recipes Informatica Humor Jokes Mensagens Curiosity Saude Video Games Car Blog Animals Diario das Mensagens Eletronica Rei Jesus News Noticias da TV Artesanato Esportes Noticias Atuais Games Pets Career Religion Recreation Business Education Autos Academics Style Television Programming Motosport Humor News The Games Home Downs World News Internet Car Design Entertaimment Celebrities 1001 Games Doctor Pets Net Downs World Enter Jesus Variedade Mensagensr Android Rub Letras Dialogue cosmetics Genexus Car net Só Humor Curiosity Gifs Medical Female American Health Madeira Designer PPS Divertidas Estate Travel Estate Writing Computer Matilde Ocultos Matilde futebolcomnoticias girassol lettheworldturn topdigitalnet Bem amado enjohnny produceideas foodasticos cronicasdoimaginario downloadsdegraca compactandoletras newcuriosidades blogdoarmario arrozinhoii sonasol halfbakedtaters make-it-plain amatha