By Chidi Anthony Opara
Subsidy waka
Occupy enter,
Another occupy follow enter.
Dis new occupy wey enter so
Na business occupy.
As occupy dey occupy,
Business occupy too dey occupy.
Company dem no dey again,
Work no dey.
Even work for di Lord vineyard
No too dey again.
Na im Abuja come full
Applicant dem full government office dem.
Dem go do occupy work,
Government dey carry dem do business occupy.
No need for application,
No need for paper.
Where need dey well well
Na to do gra-gra
And to hala well well.
Di more di gra-gra,
Di more di hala hala
Di better di pay.
Di pay na daily pay,
Na get as you work,
Na dividend of subsidy waka.
No comments:
Post a Comment