By Chidi Anthony Opara
(Fela music "government magic" play, come play small small)
Naija government say
Subsidy no dey again,
Petrol price increase sharp sharp
Transport follow increase.
Labour people say dem no gree,
Government say
Dem wan talk with labour people.
Labour people yan say
Country people dey suffer well well
So, no need for talk talk.
Labour people come yan again
Say make petrol price
Go back to before before price
Before dem go talk with government,
Government no gree.
Labour people begin plan strike,
As dem dey plan
Government too dey plan,
Plan come jam plan.
Government bring dem magic people.
Dem begin do magic,
Dem begin do mago mago.
(Music play, come play small small)
Di magic people bring one Judge
Wey no sabi justice.
Dem rub oil for di Judge mouth,
Di mouth begin leak like basket
Di Judge begin speak in tongues.
No do, no do
Di Judge don arrange
Cash 'n' carry injunction for government.
Di injunction be say
Labour people no suppose go strike,
Na waa for cash 'n' carry injunction.
(Music play, come stop)
No comments:
Post a Comment