By Chidi Anthony Opara
Naija Police talk say
Dem carry plenty police people
Go arrest one man like dat
Wey dem say
Follow blow bomb inside church for Christmas.
Naija Police come talk again say
Di man don waka.
Dem say di man waka
When five police people dey carry am
Go search im house,
I come dey shake head.
Presido come give Police oga pata pata
One day to find di man,
Police oga pata pata find another man,
Presido no gree.
One day enter one week
Police no find di man.
Presido come retire Police oga pata pata,
Write write people come dey write say
Presido don sack am.
Retire na sack?
I come dey shake head more more.
As I dey shake head,
I come see say
Another wahala group don show face.
Dem say dem comot from Boko Haram,
Dem say dem comot to fight Boko Haram.
I see say
As dem dey hala,
Security people dey smile.
E come be like say
Dis new wahala group na another government magic,
I still dey shake head.
No comments:
Post a Comment