By Chidi Anthony Opara
Naija security people
Don carry come again.
Instead to do work,
Dem dey follow criminal dem argue,
I don dey shake head again.
Naija security people talk say
Dem don catch
Boko Haram talk talk person,
Boko Haram come talk say
Na ordinary member dem catch.
Naija security people
Come reply say
Na talk talk person dem catch,
Argument come carry argument for back,
Work dey suffer,
I dey shake head more more.
Before before di argument
Na between Naija security people
And Niger delta militant dem.
Naija security people go talk say
Dem don catch
Militant dem talk talk person,
Militant dem go talk say
Na ordinary militant dem catch,
Naija security people go reply say
Na talk talk person dem catch.
Argument go carry argument for back,
Work dey suffer,
I dey shake head.
No comments:
Post a Comment