Monday, February 6, 2012

USA Africa Dialogue Series - I Dey Shake Head 3(Nigerian Pidgin English Poem)

By Chidi Anthony Opara
 
No be only Naija security people
Dey argue well well,
People
Wey dey work with Naija Presido
Dey argue well well too.
Dem too dey argue
Sotee
Dem work too dey suffer,
I don dey shake head again.
 
Presido carry dem go meeting for yonder,
Minister dem go,
Adviser dem follow,
Special Adviser dem follow.
Senior Special Assistant dem too follow,
Special Assistant dem follow,
Even Personal Assistant dem follow go.
Madam sef go,
Her worker dem follow go,
Naija government come dey empty,
Work dey suffer,
I come dey shake head more more.
 
As dem come back,
Instead to siddon do work,
Dem dey follow amebo dem argue.
Amebo dem talk say
Presido no fit win di meeting chairmo,
Presido people reply say
Presido no contest meeting chairmo.
Amebo dem talk again say
Presido contest but im no win.
Presido people come reply again say
Presido for win if im contest,
Argument
Come dey climb up, dey climb down,
Work dey suffer,
I still dey shake head.
 

No comments:

Post a Comment

 
Vida de bombeiro Recipes Informatica Humor Jokes Mensagens Curiosity Saude Video Games Car Blog Animals Diario das Mensagens Eletronica Rei Jesus News Noticias da TV Artesanato Esportes Noticias Atuais Games Pets Career Religion Recreation Business Education Autos Academics Style Television Programming Motosport Humor News The Games Home Downs World News Internet Car Design Entertaimment Celebrities 1001 Games Doctor Pets Net Downs World Enter Jesus Variedade Mensagensr Android Rub Letras Dialogue cosmetics Genexus Car net Só Humor Curiosity Gifs Medical Female American Health Madeira Designer PPS Divertidas Estate Travel Estate Writing Computer Matilde Ocultos Matilde futebolcomnoticias girassol lettheworldturn topdigitalnet Bem amado enjohnny produceideas foodasticos cronicasdoimaginario downloadsdegraca compactandoletras newcuriosidades blogdoarmario arrozinhoii sonasol halfbakedtaters make-it-plain amatha