Thursday, March 29, 2012

USA Africa Dialogue Series - Di State Of Di Nation 6 (Nigerian Pidgin English Poetry Series)

By Chidi Anthony Opara
 
My mind no good today.
Today,
My mind dey pepper me well well,
Government no care for di people of peace.
 
If country people no get house,
Dem no wan know.
If country people dey hungry,
Dem no send.
If country people dey sick,
Dem go close dem eye.
If country people dey die sef,
Dem go close dem ear.
I know di reason,
Di reason be say
We no be wahala people.
We no dey shoot shoot gun,
We no dey throw throw bomb.
 
Dem don siddon for Abuja
Dey call call wahala people,
People wey dey shoot shoot gun,
Dey throw throw bomb.
Dem dey call call dem
Make dem come talk
Wetin dey pepper dem mind.
 
E come dey look like say
We wey no be wahala people,
We wey no dey shoot shoot gun,
Wey no dey throw throw bomb,
E come dey look like say
We no matter for Naija.
 

No comments:

Post a Comment

 
Vida de bombeiro Recipes Informatica Humor Jokes Mensagens Curiosity Saude Video Games Car Blog Animals Diario das Mensagens Eletronica Rei Jesus News Noticias da TV Artesanato Esportes Noticias Atuais Games Pets Career Religion Recreation Business Education Autos Academics Style Television Programming Motosport Humor News The Games Home Downs World News Internet Car Design Entertaimment Celebrities 1001 Games Doctor Pets Net Downs World Enter Jesus Variedade Mensagensr Android Rub Letras Dialogue cosmetics Genexus Car net Só Humor Curiosity Gifs Medical Female American Health Madeira Designer PPS Divertidas Estate Travel Estate Writing Computer Matilde Ocultos Matilde futebolcomnoticias girassol lettheworldturn topdigitalnet Bem amado enjohnny produceideas foodasticos cronicasdoimaginario downloadsdegraca compactandoletras newcuriosidades blogdoarmario arrozinhoii sonasol halfbakedtaters make-it-plain amatha