Tuesday, March 20, 2012

USA Africa Dialogue Series - Grammar Full For Naija (Nigerian Pidgin English Poem)

By Chidi Anthony Opara
 
For Naija
If politician dem thief money
And dem catch dem,
Dem dey talk say
Na "political victimization" be dat.
 
If Boko bomb,
If militant dem maja,
Dem godfather dem
Dey talk say
Na "marginalization" cause am.
 
If leader dem no lead well
Dem dey talk say
Na "destructive elements" cause am.
 
If politician dem enter office today,
By tomorrow
Dem dey begin plan for another term,
Dem dey talk say
Dat another term na for "consolidation".
 
If oil money disappear
Government dey talk say
Na "cabal" dem cause am.
 
If write write people
Write bad thing dem
Wey leader dem dey do
Dem dey talk say
Na "treasonable felony".
 
If politician dem rig election win
Dem dey talk say
Na "landmark victory".
If other politician dem rig win dem,
Dem dey talk say
Na "massively rigged election".
 
Grammar
Na im full for Naija.

More On: (1) Na For Poems
                 (2) Mundane Musing And Other Poems
                 (3) Homeland Melodies And Other Poems
 

No comments:

Post a Comment

 
Vida de bombeiro Recipes Informatica Humor Jokes Mensagens Curiosity Saude Video Games Car Blog Animals Diario das Mensagens Eletronica Rei Jesus News Noticias da TV Artesanato Esportes Noticias Atuais Games Pets Career Religion Recreation Business Education Autos Academics Style Television Programming Motosport Humor News The Games Home Downs World News Internet Car Design Entertaimment Celebrities 1001 Games Doctor Pets Net Downs World Enter Jesus Variedade Mensagensr Android Rub Letras Dialogue cosmetics Genexus Car net Só Humor Curiosity Gifs Medical Female American Health Madeira Designer PPS Divertidas Estate Travel Estate Writing Computer Matilde Ocultos Matilde futebolcomnoticias girassol lettheworldturn topdigitalnet Bem amado enjohnny produceideas foodasticos cronicasdoimaginario downloadsdegraca compactandoletras newcuriosidades blogdoarmario arrozinhoii sonasol halfbakedtaters make-it-plain amatha