Friday, March 23, 2012

USA Africa Dialogue Series - “Wey Our Own?” (Nigerian Pidgin English Poem)

By Chidi Anthony Opara
 
Bomblast dey here,
Dynamite dey here,
Sinner dey here,
Thunderbolt sef dey here,
Me to
Wey be Morale
I dey here,
All of us dey here for Abuja.
 
Nobody invite us come,
Na our own national cake
Na im we find come.
 
Di thug work
Wey we do for dem
For di last election
Dem no pay us,
Na so so "transformation" grammar
Na im we dey hear everyday.
As dem dey nack di grammar,
Na so dem dey wack di national cake,
Dem say make we wait for "transformation",
Di "transformation" sef
We no see,
We no wait again.
 
Dem don come Abuja again
To come prepare for another election.
All of us dey here,
Na our own national cake
Na im we find come.
 
Oya,
Everybody put mouth
Make we talk am together;
Wey our own?
Wey our own?
Wey our own?
 
 
More On: (1) Na For Poems
               (2) Mundane Musing And Other Poems
               (3) Homeland Melodies And Other Poems
 

No comments:

Post a Comment

 
Vida de bombeiro Recipes Informatica Humor Jokes Mensagens Curiosity Saude Video Games Car Blog Animals Diario das Mensagens Eletronica Rei Jesus News Noticias da TV Artesanato Esportes Noticias Atuais Games Pets Career Religion Recreation Business Education Autos Academics Style Television Programming Motosport Humor News The Games Home Downs World News Internet Car Design Entertaimment Celebrities 1001 Games Doctor Pets Net Downs World Enter Jesus Variedade Mensagensr Android Rub Letras Dialogue cosmetics Genexus Car net Só Humor Curiosity Gifs Medical Female American Health Madeira Designer PPS Divertidas Estate Travel Estate Writing Computer Matilde Ocultos Matilde futebolcomnoticias girassol lettheworldturn topdigitalnet Bem amado enjohnny produceideas foodasticos cronicasdoimaginario downloadsdegraca compactandoletras newcuriosidades blogdoarmario arrozinhoii sonasol halfbakedtaters make-it-plain amatha