(Nigerian Pidgin English Poem By: Chidi Anthony Opara)
Everywhere for Naija
Na wahala.
For right
Na wahala.
For left
Na wahala.
For centre sef
Na wahala.
Wahala full Naija.
If e no be "Igbo Presidency",
E go be "Yoruba autonomy".
If e no be "Ogoni self-government",
E go be "Ijaw republic".
If e no be "Boko Haram insurgents",
E go be "former Niger Delta militants".
If e no be "cashless economy",
E go be "five thousand naira note".
If e no be "subsidy scam",
E go be "Bakassi".
If e no be dis,
E go be dat.
Wahala full Naija.
Even inside di Villa,
Wahala don enter.
Madam di madam
Dey for yonder
Dey take treatment
For belle bite.
Wahala full Naija.
Reproductions in part or
in whole, in whatever forms, of ChidiAnthonyOparaPoems, except for nonprofit
information and education purposes, without a written permission from the
author is not allowed.
in whole, in whatever forms, of ChidiAnthonyOparaPoems, except for nonprofit
information and education purposes, without a written permission from the
author is not allowed.
No comments:
Post a Comment