Monday, December 10, 2012

USA Africa Dialogue Series - Christmas Waka

(Nigerian Pidgin English Poem By: Chidi Anthony Opara)
 
Beeb dem don full town.
Dem don wear soft soft trouser,
Dem don wear small small shirt,
Dem don do mammy water hair.
Dem don package dem front side
Dem backside sef dem don arrange well well
Dey waka like shekeleke.
Na small small laugh,
Na aje butter voice
Dem dey take greet di men di men,
Christmas waka don start.
 
Di men di men na aristo.
Aristo na men
Wey dey carry big fine ride
Dey do dem own Christmas waka.
Dem dey cruise for town
Dey find beeb.
 
For short time joint
Na money for hand
Body for bed.
Beeb go drop bill,
Aristo go settle di bill,
Action don start be dat.
 
After after,
Drink go flow,
Chop chop go follow.
Aristo
Go dey laugh big big laugh,
Dey talk big big talk.
Beeb
Go dey laugh small small laugh,
Dey talk small small with aje butter voice.
 
 
 
Reproductions in part or in whole, in whatever forms, of ChidiAnthonyOparaPoetry/Quotes except for non-profit information and education purposes, without a written permission from the Author is not allowed.

No comments:

Post a Comment

 
Vida de bombeiro Recipes Informatica Humor Jokes Mensagens Curiosity Saude Video Games Car Blog Animals Diario das Mensagens Eletronica Rei Jesus News Noticias da TV Artesanato Esportes Noticias Atuais Games Pets Career Religion Recreation Business Education Autos Academics Style Television Programming Motosport Humor News The Games Home Downs World News Internet Car Design Entertaimment Celebrities 1001 Games Doctor Pets Net Downs World Enter Jesus Variedade Mensagensr Android Rub Letras Dialogue cosmetics Genexus Car net Só Humor Curiosity Gifs Medical Female American Health Madeira Designer PPS Divertidas Estate Travel Estate Writing Computer Matilde Ocultos Matilde futebolcomnoticias girassol lettheworldturn topdigitalnet Bem amado enjohnny produceideas foodasticos cronicasdoimaginario downloadsdegraca compactandoletras newcuriosidades blogdoarmario arrozinhoii sonasol halfbakedtaters make-it-plain amatha