By Chidi Anthony Opara
Naija people sabi yan,
Naija people like yan.
Dem like talk talk pass food,
Dem like talk talk pass water.
Di time for vote
Na politician dem wey talk pass
Na dem
Country people dey vote.
Talk talk ceremony dem
Full remain for Naija.
If e no be conference,
E go be symposium
Or e go be colloquium.
Everyday everyday
Talk talk group dey show face.
If e no be youth forum,
E go be women league
Or e go be men vanguard.
Now Naija Presido
Don kick ball enter eighteen.
Presido don bring another talk talk.
No do, no do
Country people go begin yan again.
Dem go yan sotay
Dem go forget again say
Nothing dey happen for Naija.
Dem go yan sotay
Dis Presido go go,
Another Presido go show,
Dat one sef go bring another talk talk.
(This poem is presented as a social service, all rights reserved.)
--
You received this message because you are subscribed to the "USA-Africa Dialogue Series" moderated by Toyin Falola, University of Texas at Austin.
For current archives, visit http://groups.google.com/group/USAAfricaDialogue
For previous archives, visit http://www.utexas.edu/conferences/africa/ads/index.html
To post to this group, send an email to USAAfricaDialogue@googlegroups.com
To unsubscribe from this group, send an email to USAAfricaDialogue-
unsubscribe@googlegroups.com
---
You received this message because you are subscribed to the Google Groups "USA Africa Dialogue Series" group.
To unsubscribe from this group and stop receiving emails from it, send an email to usaafricadialogue+unsubscribe@googlegroups.com.
For more options, visit https://groups.google.com/groups/opt_out.
No comments:
Post a Comment