Ena Ofugara :
Any man wey marry this one get plan.
1. Either na say he dey owe many people or he no like pay landlord house rent
2. Na gay and he no want make dem arrest am or send am go jail for 14 years so he kuku marry woman-man
But Godabegggooooooooo —
Standard English translation froim Nigerian Pidgin English above
Any man who marries this one has a plan.
1. Either he owes many people money or he does not like to pay his landlord house rent
2. He is gay and he does not want to be sent to jail in Nigeria for 14 years so he marries a woman-man
But Godabegggooooooooo
Responses :
Agberhiere C Eseoghene : Loll lolololol you I forget say day done break for America
28 March 2014 at 13:29 · Like
Riete Ofugara if you no see food when you come house, na u go apologize for coming too soon. Godabegggggggoooooooooo.
28 March 2014 at 13:31 · Unlike · 5
Ena Ofugara : Riete Ofugara apologize for coming too soon haahahahahahahahahahahahahaha
28 March 2014 at 13:32 · Unlike · 2
Riete Ofugara : if you vex, she go beat you...if she vex, she go beat you...so no vexing for the house.
28 March 2014 at 13:33 · Unlike · 5
Ena Ofugara : You go dey beg am "can i watch Chelsea vs Arsenal or u want to watch news or you like the TV off?
28 March 2014 at 13:34 · Unlike · 3
Riete Ofugara : this one go watch wrestling......instead!
28 March 2014 at 13:36 · Unlike · 5
Ena Ofugara : Guy, you go wash pant with hand as she no dey like make dem use machine wash her G-string. You go be like who keep lion for house as pet
28 March 2014 at 13:38 · Unlike · 1
Rita Oboh Chim : Hahahahaha in paragraph, so men still dey fear beat? Na new one I hear today. I think say na only woman dey fear before o. Oghene migwor
28 March 2014 at 13:39 · Like · 2
Agberhiere C Eseoghene : Lololololol Bros Riete you are very correct,you vex you are in trouble...Na Fela dey call suffering and smiling
28 March 2014 at 13:40 · Unlike · 5
Ena Ofugara: Rita Oboh Chim oh girl! Talk well oh. weda man dey fear beat? Oya tell your husband make he go tif tatache for market. He go tell you how group beat dey be. Only this woman na group beat
28 March 2014 at 13:40 · Like · 1
Ena Ofugara : Timeless Ese na my papa first pikin be Riete Ofugara na him senior me
28 March 2014 at 13:41 · Unlike · 1
Agberhiere C Eseoghene : I know bros,Na u I nor know!!!!lolol
28 March 2014 at 13:43 · Unlike · 1
Riete Ofugara : if you get this woman, no need to buy dog..cause i sure say she dey bark !!
28 March 2014 at 13:43 · Unlike · 3
Rita Oboh Chim : I be think say because of our Africa men Bloated ego, woman nor go fit beat dem
28 March 2014 at 13:45 · Unlike · 1
Ena Ofugara : Once u eff up, she go just use Vaseline baby oil rub her full body, then dey bend head go this and that corner like Tyson then begin ripple her muscles. Na then you phone police with whisper make she no hear "There is a murder. Somebody is dead" Police go ask "who"? You go reply "me"
28 March 2014 at 13:46 · Unlike · 2
Riete Ofugara : no let this woman hear that statement before she organize public beating for her husband oooo
28 March 2014 at 13:46 · Unlike · 2
Ena Ofugara : If she no see dumbells, na her husband she go dey carry up and down dey count "one two three four ...twenty, twenty one...." na so the man go dey air as she dey use am do boody building
28 March 2014 at 13:48 · Unlike · 4
Riete Ofugara : ..and she make-up. see her lips..Godabeggggggoooooo
28 March 2014 at 13:50 · Unlike · 2
Ena Ofugara: She set yansh sef. She want use ikebe entice. but the yansh go strongggggggg. Injection fit no enter make we no talk go osho side. In fact her bicep and back big pass the ikebe. The bicep na Ikebe sef
28 March 2014 at 13:52 · Unlike · 2
Rita Oboh Chim : @Ena So you nor go report and summon her go family meeting make dem sort out una issues?
28 March 2014 at 13:53 · Unlike · 2
Riete Ofugara : choose meat before am na..
28 March 2014 at 13:53 · Unlike · 2
Ena Ofugara : Rita Oboh Chim as you see my senior bros Riete Ofugara so, you feel say he go attend family meeting where them summon this woman? if she vex nko?????
28 March 2014 at 13:55 · Unlike · 2
Rita Oboh Chim : I dey roll for ground oh,
28 March 2014 at 13:57 · Unlike · 3
Rita Oboh Chim : Na you say okro nor dey big man e owner
28 March 2014 at 13:57 · Unlike · 3
Riete Ofugara : na conference call family go use o!!
28 March 2014 at 13:58 · Unlike · 7
Rita Oboh Chim : Nor worry if you enter mountain of fire, she go change, there is nothing God can not do
28 March 2014 at 13:58 · Unlike · 2
Ena Ofugara : Rita Oboh Chim anything wey make Riete Ofugara attend na say he bring body guard wey hold long gun and even then na me he go blame say why I go chop meat wey she never chop eba finish. Everything i do must wrong as long as she attend the meeting
28 March 2014 at 13:58 · Unlike · 3
Ena Ofugara : hahahaha @conference call. my belle ohhhhh
28 March 2014 at 13:59 · Unlike · 3
Ena Ofugara : Rita Oboh Chim change cloth or change to??? prayer dey reduce muscles?
28 March 2014 at 14:00 · Unlike · 1
Rita Oboh : Chim Pray for her, when woman husband dey out of order friends and family go say pray, he will change and God will touch him,
28 March 2014 at 14:01 · Unlike · 3
Riete Ofugara : i still dey imagine how person mama go feel when u introduce this woman to her as future wife.......she go shout BLOOD OF JESUS!!!
28 March 2014 at 14:04 · Unlike · 6
Ena Ofugara : She fit fear no shout ohhhh
28 March 2014 at 14:07 · Unlike · 5
Agberhiere C Eseoghene : Bros Riete go kill person with laugh Today,,Ena I say u dey learn for were senior man dey!!!!!Ose I give millions of Uhrobo gun shot to u!!!!!!
28 March 2014 at 14:11 · Like · 4
Blessing Victor Meteke :Hahhahahahahaha. Ena, sure knows how to caption all these photoshoped pics.
28 March 2014 at 14:15 · Like · 1
Ena Ofugara: Blessing Victor Meteke photoshopped? You definitely do not follow body-building. There are thousands of women just like her...thousandss
28 March 2014 at 14:16 · Like · 2
Blessing Victor Meteke: Ena Ofugara, this particular one na real?
28 March 2014 at 14:24 · Unlike · 1
Oluwatoyin Vincent Adepoju : Ena Ofugara!
You are in a class on your own!
I neva laf like dis in ages!
28 March 2014 at 14:38 · Like · 1
Ena Ofugara : Oluwatoyin Vincent Adepoju as no be this kine woman you marry, you fit laugh. Who marry this one go know wetin Terry Tha rapman really mean wey he say "Boys are not smiling". You cannot smile if u marry this one....except she shout for you say "SMILE".
28 March 2014 at 14:41 · Unlike · 3
Oluwatoyin Vincent Adepoju : Bros Ena Ofugara, from today, I am a regular on your wall.
Are you not that guy who wrote twice on Don Pedro and broke the news of his getting the award from the Oba of Benin?
28 March 2014 at 14:44 · Like · 1
Nosa Ogbeifun : Ena Ofugara Abeg no talk laff end me here. Jesus!
28 March 2014 at 14:48 · Unlike · 1
Agberhiere C Eseoghene : @Olu u are correct,He was the one that wrote about Don Pedro!!!!!
28 March 2014 at 14:53 · Unlike · 1
Oluwatoyin Vincent Adepoju : Thanks, Timeless Ese.
The guy is heavy.
28 March 2014 at 14:56 · Like
Oluwatoyin Vincent Adepoju : I need to save and distribute this classic thread and post.
Does any contributor object?
28 March 2014 at 15:34 · Like
Dmx Ibrahim Fatima : Na wetin
28 March 2014 at 19:06 · Like
Lucky Amregbare : Nice one Ena and am sharing! Riete i agree with u, family meeting na thru conference call bcos any attempt to go against her, ear go ringggggggggg!
28 March 2014 at 19:15 · Like
Asiegbu Okey Obasi : Ena talk say okro no de tall pass who plant am last week for one of I'm post while referring to a guy and I'm babe, I wan ask weda this one follow for that proverb?
29 March 2014 at 05:01 · Like · 1
David Fekete : I beg dem mould her back.only d back go beat person
29 March 2014 at 09:23 · Like
Rosy Jonah : NA WA OH
29 March 2014 at 10:32 · Like
Mazi Kenechukwu Nwachinemere : Chai
29 March 2014 at 10:44 · Like
Ena Ofugara : @Asiegbu Okey Obasi this na okro for your eye. Or na Iroko tree?
29 March 2014 at 13:18 · Like · 1
Asiegbu Okey Obasi : Lol, na rock no be even iroko. Imagine say this one na person step mother.
29 March 2014 at 13:26 · Like · 2
Ebiuwhe 'sleekworld' Ochuko : Hahaha... Why are u guys beefing? She's still got a tiny waist, no matter how bad. Heard most guys are suckers for tiny waists *abi na lie?*:p
29 March 2014 at 13:37 · Like
Toritseju Augustine Boyo : Ena, u nor go kill person o!
29 March 2014 at 18:17 · Like
Ena Ofugara : Na Riete Ofugara get this post with that "conference call" comment.
29 March 2014 at 18:18 · Like · 1
Akinbami Joseph : Chai! this ThInG na person abi JuJu?
29 March 2014 at 20:32 · Like
Ena Ofugara : Akinbami Joseph u want serve am? haha
29 March 2014 at 20:32 · Like
Ena Ofugara : Ogeah Uzoamaka u will find the exchange funny
29 March 2014 at 20:32 · Like
Akinbami Joseph : Lai Lai! If na person, I no go fit sleep for im area. If na juju, I go de attend Mountain of fire and petroleum ministry till im go comot for area.
29 March 2014 at 20:44 · Like
Sylvia Selasi Ofori-Dwumfuo : I keep laughing. First at the caption, then THE COMMENTS!
Source : Ena Ofugara's Facebook wall post of 28 March 2014.
Ena Ofugara is a Nigerian-American writer whose focus is political activism, social commentary and comedy through his Facebook page.
I hereby present an example of what I consider one of his most memorable postings and readers' response threads.
The language used is Nigerian Pidgin English, Nigeria's lingua franca, which Ena Ofugara is fluent in from reaching maturity in Southern Nigeria.
Listserv moderated by Toyin Falola, University of Texas at Austin
To post to this group, send an email to USAAfricaDialogue@googlegroups.com
To subscribe to this group, send an email to USAAfricaDialogue+subscribe@googlegroups.com
Current archives at http://groups.google.com/group/USAAfricaDialogue
Early archives at http://www.utexas.edu/conferences/africa/ads/index.html
---
You received this message because you are subscribed to the Google Groups "USA Africa Dialogue Series" group.
To unsubscribe from this group and stop receiving emails from it, send an email to usaafricadialogue+unsubscribe@googlegroups.com.
For more options, visit https://groups.google.com/d/optout.


No comments:
Post a Comment