By Chidi Anthony Opara
Naija polithiefcian dem,
Some dey wear uniform,
Some dey wear civilian cloth.
Some go school,
Some no go school.
Some just dey claim certificate,
All of dem just dey make mouth.
Naija polithiefcian dem
Dey tie wahala like wrapper.
Dem don carry dem wahala
Wan come spoil we jolly,
Dem don carry dem katakata
Wan come spoil we valentine.
Naija polithiefcian dem,
Dem body sabi busy well well.
Dem don busy sotay
Dem carry dem yeye election
Abi na selection sef?
Put for di day
Wey we dey jolly valentine.
No be say Naija election
Dey dey coolee sef,
Naija election na katakata.
Baba God don help us.
Naija polithiefcian dem
Don carry dem busy body
Comot dem yeye election
For di day of we valentine jolly.
Country people,
Make we forget Naija polithiefcian dem,
Make we forget Naija yeye election,
Make we first jolly valentine jare.
(Poem presented as social service, all rights reserved.)
--
Listserv moderated by Toyin Falola, University of Texas at Austin
To post to this group, send an email to USAAfricaDialogue@googlegroups.com
To subscribe to this group, send an email to USAAfricaDialogue+subscribe@googlegroups.com
Current archives at http://groups.google.com/group/USAAfricaDialogue
Early archives at http://www.utexas.edu/conferences/africa/ads/index.html
---
You received this message because you are subscribed to the Google Groups "USA Africa Dialogue Series" group.
To unsubscribe from this group and stop receiving emails from it, send an email to usaafricadialogue+unsubscribe@googlegroups.com.
For more options, visit https://groups.google.com/d/optout.
No comments:
Post a Comment