De Tin Wen Dey Make Person Happi
De First Book : Were Fire Dey Burn
Part 1
Commedia Wen Italian Bukuru Man Dante Alighieri Write
Don Enter Naija Pidgin
Oluwatoyin Vincent Adepoju
Comparative Cognitive Processes and Systems
"Exploring Every Corner of the Cosmos in Search of Knowledge"
I Salute Una
De People Wen Put Fire for My Bodi to Do Dis Work
Monica Boria and de Cambridge Tok Togeda for Carri Mata from One Language to Anoda Langue Pipol
Cambridge Conversations in Translation
wen tok say make I carri Dante enter Naija Pidgin after dem see how I carri T.S.Eliot enter Naija Pidgin for deir workshop
Monica Boria wen encourage and guide me
Babake Wen Get Book for Inside Bodi (Professor ) Robin Kirkpatrick, oga kpata kpata for Dante mata wen encourage me well well
Jhalobia Recreation Park and Gardens Lagos wen sponsor my bukuru waka for obodo oyibo England
Were Fire Dey Burn
Part 1
As I Dey Run From three Animals Wen Dey Poshu Me, Virgil Come Save Me
As William Blake paint am
As I waka reach de middle of dis life wen we dey
I open my eyes see say I don loss.
Na inside forest I dey
De place na helele.
My mout no reach to tok as de place fear me.
Even as I dey tok am now, de fear dey make me cold for inside blood.
de tin pass make person die.
But beta come commot for dat mata
So I go tok de tori.
I no know how I come enter dere
E be like say na sleep catch me
Na im I waka go where I no suppose go.
I come reach bottom of one hill
Inside de place where I loss put.
Na im I see say light dey reach dere
Light when come from dat planet when dey let us see road.
My bodi come down small
Come dey relax de fear when sidown for my belle like river
river wen dey flow for my belle
De whole night when I dey dat terrible forest.
As my bodi come down
I come be like person wen dey swim
Dey look de place where e don pass
As e still dey gader bodi wen e don reach land.
Na so I be.
I tink say my wahala don finish
For dis place where no person wen dey alive don pass till me.
I rest bodi small
Den come dey climb de hill jeje.
Na im one animal come block road
Many spots dey im bodi
Leopard!
E come dey waka come where I dey.
Day just dey break
Sun dey rise
De stars wen dey rise wit sun dey rise too
Dose stars wen rise when de love wen make dis world first make every tin wen dey world.
As day break like dis
I come dey get heart
Fear dey comot small small
But
Na im lion come appear
Dey waka toward me
E be like say hungry dey catch am
Even de air round am dey shake.
Den wolf come appear
De kine wen dey always dey hungry even when e don chop
De kine wen don kpafuka many people life.
My bodi just weak.
I no get hope again say I go fit climb de hill comot dat place.
I come be like person wen dey happy say e don gader money
Den come see say de money don loss
Im whole mind go full wit de cry for dat money.
Na so I come be.
Dat terrible creature wen gader wahala for bodi
Dey waka come were I dey
Me I dey move back to de place for forest were light no dey from where I bin tink say I don escape.
As I dey move back wit fear
Sometin come pass
Like person
E no tok
As if say e neva tok for long time
As I see am for dat place were person no dey were fear wan kill me
I come shout
'I beg help me, weda you be person or spirit'
'I no be person, but I be person before tay tay' na so de voice answer
'Na from Lombardy I be
My papa and mama na from Mantua
Na for Rome I dey
Wen Augustus be king dere
When all de gods wen dey dere dey lie and cheat people.
I dey sing beautiful songs
Like I sing praise de son of Anchises
When comot Troy after Troy burn reach ground.
Why you dey move back
You no wan climb again that beautiful hill?
Al beta tins wen dey make person happi dey dere
See as the top dey shine'
'Kai!
You be Virgil?!
De river wen dey comot from you as you dey write na im be my food.
De power dey enter my own writing
Make my power rise
All de time wen I take look inside your work
Make all dat enter my bodi!' na so I answer.
'No problem. I go help you but why you no wan climb dat mountain wen all de beta of de world dey?' e ask again.
'You no see all dose animals wen wan chop me? I tell am.
'No worry. I go carry you pass anoda road wen dem no dey.
Person dey come when go deal with dem.
Person wen full of sense and pure love, wen notin dey shake.
He go pursue dem back to Hell where dem remove dese animals from' na so he answer.
He come continue:
'Make I help you comot here go were everitin wen you dey find you go see, dat beta life wen no dey finish.
To reach dere sha, we go pass were people dey cry as if world don end
People wen don die but who wan die again make deir suffering finish.
From dere we go look dose people wen fire dey burn
But dem dey happy
Because de fire dey remove bad tins for deir bodi.
So dat dem fit go better place were dem no fit enter wit dose bad tins wen dey deir bodi.
From dere we go reach de place were God dey.
Na anoda person go carry you enter dere.
Person wen dey qualify pass me.
King dey dat place.
But because I no serve de king when I dey world, he no go let me enter im city.
Na him dey control de whole city, from dat place where im trone dey
People when fit enter dere, deir own don beta.'
'My broda when dey sing sweet music, I take the name of God beg you, even though you no know dat God when you dey world.
Help me commot dis place when dey make my heart shake and where oder terrible tins fit happen.
I beg carry me go de gate were St Peter dey after we don pas all dose people when dey cry.' I almost dey cry as I dey beg am.
E come dey climb de hill.. I follow am from behind.
Dis tori also dey
De Tin Wen Dey Make Person Happi blog
Listserv moderated by Toyin Falola, University of Texas at Austin
To post to this group, send an email to USAAfricaDialogue@googlegroups.com
To subscribe to this group, send an email to USAAfricaDialogue+subscribe@googlegroups.com
Current archives at http://groups.google.com/group/USAAfricaDialogue
Early archives at http://www.utexas.edu/conferences/africa/ads/index.html
---
You received this message because you are subscribed to the Google Groups "USA Africa Dialogue Series" group.
To unsubscribe from this group and stop receiving emails from it, send an email to usaafricadialogue+unsubscribe@googlegroups.com.
For more options, visit https://groups.google.com/d/optout.


No comments:
Post a Comment